Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 40

Abeg click here to share dis post

Dis Na Song Of Freedom

  1. To di music producer. Dis na Psalm of
    David. I cool down wait for Baba-God, he reason me—and he hear my cry.
  2. He carry me komot from inside dark
    hole—wey portor-portor dey; and he put my leg on top of rock, con stand my leg gidigbam.
  3. He put new song for my mouth, praise
    Baba-God. Many pipo go see am—con fear, con put dia trust on Baba-God.
  4. Blessings for di man wey trust Baba-God, wey no dey respect pipo wey dey
    make-mouth, wey no dey turn follow wayo.
  5. Oh Baba-God my Oga, di ogbonge tins
    wey you don do brekete, and your plan for us; no- pesin fit compare to you. If I wan yarn or tok about dem, dem go too plenty for me to tok.
  6. Sacrifice plus offering wey you no really want, but you don open my ears. Burnt offering, plus sin offering wey you no need.
  7. I con tok sey, “Na me be dis, I don
    come—dem write about me for inside di books.
  8. Oh Baba-God I dey happy to do your
    wish; your law dey for inside my heart.”
  9. I don tok about di good news of your
    goodness for where plenty pipo gada put; oh Baba-God, you sef know sey I no dey close my lips.
  10. I no dey hide your goodness for inside my heart; I don tok about your faithfulness and how you take save me. I neva hide your soft-love and truth from di plenty pipo.
  1. No hide your soft mercy from me Oh
    Chineke; make your soft- love, plus your truth always protect me.
  2. Plenty-plenty evil wey I no-fit count don round me. My sins don cover me sote I no-fit look up. Dem plenty pass di hair wey dey for my head—so my heart dey fail me.
  3. Oh Baba-God, make body sweet you to save me. Oh Baba-God, kiakia come epp me.
  4. Make shame and katakata catch all those pipo wey wan make I kpeme. Pursue dem go
    back, and disgrace all those pipo wey dey wish me evil.
  5. Make all those pipo wey dey tell me sey, “Aha! Aha!”—Make dem confuse becos of dia shame.
  6. But make all those pipo wey fyne
    you—happy, con celebrate inside you. Make all those pipo wey love your
    salvation—always tok sey, “Make Baba-God get level!”
  7. But I poor and I need epp, but Baba-God dey reason my mata. Na you be my epp, and na you dey save me; Oh Baba-God, no waste
    time.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website