Psalm Chapter 102
Di Cry For Epp Of Man Wey Dey
Face Wahala
- Dis na prayer for pesin wey dey face
wahala, wey don taya, and wey dey cry to Baba-God. Hear my prayer, Oh Baba-God; make my cry for epp come meet you. - No hide your face from me wen I dey
face wahala. Turn your ears come my side; ansa me kiakia wen I call. - My days dey vanish like smoke; my
bones dey burn like charcoal. - My heart dey feel pain and e don dry like grass—sote I dey forget to chop my food.
- Becos of my loud cry, I don slim down to lekpa.
- I be like pelican for desert, I be like owl wey dey for empty land.
- I no-fit sleep, I dey alone like bird wey
dey on top house. - From morning till night my enemies dey yab me; those pipo wey dey insult me dey swear against me.
- I dey chop ashes as food—con mix my drink wit tears.
- Becos you dey vex for me and you dey
para for me—you carry me up, con throway me put for one corner. - My days be like evening shadow; I dey
dry dey go like grass. - But you, oh Baba-God—you go sidon
for king-chair forever; and dem go
remember your name for all generations. - You go stand up—con sorry-for Zion,
time don reach to show her favour; na dis be di right time. - Your servants love di stones of Zion; and dem love even di dust of Zion.
- Di nations go fear Baba-God name, all di kings of di earth go fear your levels.
- Baba-God go build Zion again; he go
show-face inside hin glory. - He go ansa di prayer of poor pipo; and he no go fashi dia prayer.
- Dem go write dis tin for future
generation, so dat pipo wey dem neva born go cut-cap for Baba-God. - “Baba-God look down from hin holy-place from up-up, he look di earth from heaven,
- to hear di cry of prisoner, and to free those pipo wey dem don condemn to death.”
- So dat dem go tok about Baba-God name for Zion, and about hin praises for inside Jerusalem,
- wen di pipo and di Kingdoms gada to
worship Baba-God. - He don make my strength weak for my way, and he cut my days short.
- So I con tok sey, “Oh Baba-God no let
me die young—your years dey for all
generations! - From starting, you set di foundations of di earth, and di heavens na your handwork.
- Dem go fade komot—but you go dey.
Dem go fade like cloth.
You go change dem l ike cloth—and you go change dem. - But you still dey di same, and your years no go ever end.
- Your servant pikin go kontinu; dia pikin-pikin-pikin go stand gidigbam for your front.”