Psalm Chapter 42
I Wan Drink Baba-God Like Water
- To di music producer. Dis na Maskil for di son of Korah. As deer take dey breath-fastfast dey fyne water to drink, naso my heart sef dey fyne you—Oh Baba-God.
- My soul dey fyne di living God like man wey wan drink water. Wen I go show-face for Baba-God front?
- Na my tears I dey chop from morning till night as pipo dey always tell me sey, “Where your God dey?”
- Wen I remember all dis tins—my heart
dey pour-throway wit pain; I bin dey follow plenty pipo wey bin dey march go Baba-God house, as we dey shout wit happiness plus praise to Baba-God. - Chai my soul, why you put yoursef for
ground? Why na worry-worry full inside me? Hope on Baba-God, I go still praise am for di epp of di light wey he dey shine on me. - Oh my God, my soul dey low- key inside me; so I go remember you from di land of Jordan, from up-up of Hermon—from Mountain of Mizar.
- Big-river dey call anoda big-river for di
sound of di water dey fall—all your waves plus high- water don cover me. - Baba-God dey command hin soft-love
for day time, and hin song go dey wit me for night—na prayer to Baba-God wey get my life. - I go tell Baba-God wey be my Rock sey, “Why you don fashi me? Why I dey cry becos di enemies dey oppress me?”
- My enemies dey laff me like sey dem dey break my bones—everi day, dem dey tell me sey, “Where your God dey?”
- Why you dey feel sad-chai, my soul?
Why worry-worry full inside me? Put your hope on Baba-God, I go still praise am, Baba-God wey dey epp me shine—and my God.