Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 56

Abeg click here to share dis post

Dis Na Prayer Of Trust

  1. To di producer of music. To di tune of
    “Silent Dove for far-far land.” Dis na
    Michtam of David—wen di Philistines catch am for Gath.
    Sorry-for me, oh Baba-God, men wan
    swallow me; dem dey fight and oppress me everi day.
  2. My enemies dey pursue me from
    morning till night, pipo plenty wey dey fight me, oh Most High.
  3. Wen fear dey catch me, I go trust you.
  4. Inside Baba-God (I go praise hin word), na Baba-God I trust; fear no go catch me. Wetin ordinary men fit do me?
  5. From morning till night, dem twist my
    words; all dia tinking na against me.
  6. Dem gada to plan bad tins for my back, dem hide, dem dey look me as I dey waka—as dem dey wait to kill me.
  7. Abi dem go escape inside dia
    wickedness? Oh Baba-God, bring down di pipo as you dey vex!
  8. You don record all my waka- waka, put my tears inside your bottle—abi dem no dey inside your book?
  9. Naso my enemies go turn back wen I call you for epp. I know dis tin, becos Baba-God dey for me.
  10. Inside Baba-God—I go praise hin word, inside Chineke—I go praise hin word.
  11. Na Baba-God I dey trust; fear no go
    catch me. Wetin men fit do me sef?
  12. I go fulfil my promises to you, oh Baba-God, I go sing praises to you.
  13. You don save me from death, and na you make me no fall, so dat I go fit waka for your front—for di light of life.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website