Psalm Chapter 57
Baba-God Abeg Epp
- To di producer of music. Set di music to, “No Dabaru.” Dis na poem of David—wen he dey run from Saul inside rock. Sorry-for
me, oh Baba-God, sorry-for me! My soul trust you. And I go hide inside di shadow of your feathers until wahala waka pass. - I cry out to you Baba-God Most High, I cry to Baba-God wey dey do everitin for my life.
- He go send from heaven, and he go save me, he dey disgrace di pesin wey wan swallow me. Baba-God go send hin mercy plus truth.
- My soul dey for among lions; I dey sleep among men wey dia blood dey hot—men wey get teeth like long-sharp-weapon and arrow, men wey dia tongue sharp like sword.
- Oh Baba-God, make you high pass di heavens, make your levels big pass di whole earth.
- Dem throw net for my leg; my soul bow down. Dem dig hole for my road—but na dem fall inside di hole.
- My heart dey faithful, Oh Baba-God; my heart dey faithful. I go sing—con praise you.
- Wake up, my soul! Wake up, harp and lyre! I go wake up di morning.
- Oh Baba-God, I go praise you among di Nations; I go sing to you—among di pipo.
- Your mercy high reach heaven; your truth reach di clouds.
- Oh Baba-God, make your level rise pass heaven; make your levels high pass di earth.