Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 75

Abeg click here to share dis post

Baba-God Go Judge Wit Hin
Church-mind

  1. To di producer of music. Set am to “No Scata.” Dis na song—Psalm of Asaph. Oh Baba-God, na you we dey give tanks, na you we dey give tanks, becos your works na ogbonge, we go tok sey your name dey near.
  2. You tok sey, “Wen I choose di right time, I go judge wit my church-mind.
  3. Wen di earth plus everi-pesin wey dey
    inside am start to dey melt, na me dey stand di pillars gidigbam.
  4. I tell those pipo wey dey make- mouth
    sey, ‘No dey buga again,’ and to di wicked pipo, ‘No rise your horn go up!
  5. No dey rise your horn against heaven, or dey make-mouth as you dey do anyhow.’ ”
  6. Promotion no dey come from di east or west, or from south.
  7. But na Baba-God dey judge; he dey
    bring one pesin down, and he dey carry anoda pesin go up.
  8. Cup dey for Baba-God hand—and di
    wine dey red, he don mix am wella. He dey pour am come out, and all di wicked for di earth dey drink am reach di last drop.
  9. But as for me, I go tok about Baba-God forever; I go sing praises to di God of Jacob.
  10. All di horns [pawa] of wicked pipo go
    cut komot, but good pipo horns go raise up.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website