Psalm Chapter 83
Dis Na Prayer To Fall My Enemies
- Dis na song—na Psalm of Asaph. Oh
Baba-God, make you no dey silent; no keep quiet, Oh Baba-God, no just dey like dat. - See as your enemies dey ginger, see as pipo wey no like you dey carry dia head up.
- Dem dey plan wuru-wuru for your pipo; and dem dey plan bad tins against di pipo wey you dey protect.
- Dem tok sey, “Come make we scata dem, make dem no-fit form dia nation; so dat pipo no go fit remember di name of Israel again.”
- Dem plan togeda wit one mind; dem sign agreement to change am for you—
- di pipo of Edom, plus di Ishmaelites;
Moab plus Hagrites, - Gebal, Ammon and Amelek, Philistia
wit di pipo of Tyre. - Even Assyria don join dem: dem don epp Lot pikin.
- Do dem wetin you do to Midian, Siseria and Jabin for di river of Kishon,
- wey kpeme for En Dor, dem con be like yama-yama for ground.
- Make dia leaders be like Oreb and Zeeb, yes, all dia princes like Zebah and Zalmunna,
- wey tok sey, “Make we claim Baba-God land as awa own property.”
- Oh Baba-God, make dem be like dust
inside breeze—like chaff for inside breeze! - As faya take dey burn forest, and as faya dey burn for mountain,
- naso you go pursue dem wit your heavy-breeze, and make dem fear wit your strong-breeze.
- Oh Baba-God, use shame cover dia face so dat dem go fyne your name.
- Make shame and fear catch dem forever, make dem kpeme wit disgrace.
- Make dem know sey you—wey na only
your name be Baba-God, and na you be Oga kpatakpata for di full earth.