Psalm Chapter 97
Baba-God Pawa
- Baba-God dey reign, make di earth dey happy; make di plenty islands jolly.
- Cloud plus darkness dey around am;
goodness plus justice na di foundation of hin govment. - Faya dey burn for hin front—wey dey
burn all hin enemies round am. - Hin lightning dey give di world light; di
earth see am—and dem con dey shake. - Di mountains dey melt like candle-water for Baba-God front, for front of di Oga kpatakpata of all di earth.
- Di heavens dey tok about hin goodness, and all di pipo dey see hin levels.
- Make shame catch all di pipo wey dey
worship idol—those pipo wey dey make-mouth wit dia idols. Make all di gods worship am! - Zion hear am—con dey celebrate, and di daughters of Judah dey happy—becos of your judgement, Oh Baba-God.
- Oh Baba-God, na you be di Most High
for di whole earth; you get levels pass all di gods. - Make all of una wey love BabaGod—hate evil tins. He dey guard di lives of
hin holy-pipo, con komot dem from wicked pipo hand.
- Light dey shine for good pipo, and
happiness dey for di pipo wey get clean-heart. - Jolly inside Baba-God, all of una wey be beta pipo, and praise hin holy name.