Psalm Chapter 145
David Psalm Of Praise
- Dis na Psalm of praise of David. I go
tuale for you, my God di King; I go bless your name for ever and ever. - I go praise you everi day, and I go cut-cap for your name for ever and ever.
- Baba-God na ogbonge! And he get full
levels to receive awa praise. No-pesin fit reason hin greatness. - One generation go tok beta tin about
your work to di next one; dem go tok about your great works.I go meditate on di high levels of your highness, and your ogbonge works. - Men go tok about di pawa of your elele works, and I go tok about your ogbonge works.
- Dem go gist about di memory of your goodness wey brekete, con sing about your kindness.
- Baba-God dey show hin grace, and hin soft-heart brekete. He no dey quick vex, and he dey sorry-for pesin well-well.
- Baba-God dey good to everi- pesin; hin soft mercies dey for everitin wey he make.
- Oh Baba-God, everitin wey you don
- make go praise you, and all your holy-pipo go bless you.
- Dem go tok about di levels of your Kingdom, con tok about your pawa,
- so dat all men go know about your ogbonge works, and di beautiful levels of your Kingdom.
- Your Kingdom na everlasting Kingdom, and you dey rule for all generations.
- Baba-God dey carry all those pipo wey fall, and he dey carry pipo wey dey don break down.
- Everi-pesin eyes dey look your face wit hope, and you dey give dem dia food for di right time.
- You open your hand, con provide for di wish of everi living tin.
- Baba-God dey good for all hin ways, and he dey show kindness for everitin wey he dey do.
- Baba-God dey near to all those pipo wey dey call am, he dey near all those pipo wey dey call am wit truth.
- He dey give those pipo wey dey fear am wetin dem wish for; he go hear dia cry sef, and he dey save dem.
- Baba-God dey protect everi- pesin wey love am, but he go scata all di wicked pipo.
- My mouth go tok about Baba-God praise. Make everi creature praise hin holy name for ever and ever.