Romans Chapter 16
Greetings
1. I wan tell una beta tin about one of awa correct sista—Phoebe, wey be servant of di church wey dey for Cenchrea.
2. Make una receive her wit levels in Christ, wit di kain way dem take dey welcome God-pipo, and make una give her any kain epp wey she need from una. She don epp plenty pipo, even me sef.
3. Greet Priscilla, and Aquila—wey dey epp me inside Christ Jesus.
4. Dem don risk dia life becos of me. No be only me dey tank Baba-God for dem, but all di churches of di Gentile.
5. Still greet di church wey dey meet for dia house. Greet my dear padi—Epaenetus wey be di first to accept Christ for Asia. 6. Greet Mary wey hustle hard for una.
7. Greet Andronicus and Junia, my brodas wey don dey for inside prison wit me—and wey di apostles wey accept Christ before me—dey respect.
8. Greet Ampliatus, wey I love inside Christ.
9. Greet Urbanus, awa fellow hustler for inside Christ, and my correct padi—Stachys
10. Greet Apelles—wey dem confam for Christ. Greet those pipo wey dey Aristobulus caban.
11. Greet Herodion, my fellow Jew. Greet those pipo wey dey Narcissus house wey belong to Christ.
12. Greet Tryphena and Tryphosa, those women wey dey hustle hard for Christ. Greet my correct padi—Persis, wey don work very hard for Christ.
13. Greet Rufus wey BabaGod don choose, and hin mama, wey be like14. Greet Asyncritus, Phlegon, Hermes, Patrobas, Hermas, plus di brodas wey dey wit dem.
15. Greet Philologus, Julia, Nereus, and hin sista, plus Olympas, and all God-pipo wey dey wit dem.
16. Use holy kiss take greet unasef. All di churches of Christ dey throway-salute.
Paul Ginger Di Holy-pipo To Gum-body
17. I dey beg una, brodas—watch out for those pipo wey wan divide una, and block una road—pipo wey no dey follow di teaching wey una don learn. Make una no near dem.
18. All those kain pipo no dey serve awa Oga Jesus Christ, but na dia belle dem dey serve, and wit whyning and sweet-mouth dem dey scam di heart of innocent pipo.
19. Everi-pesin don hear as una take dey obey Baba-God, so I dey happy becos of una; but I wan make una get-sense to do di right tins, and to dey innocent—for evil tins.
20. And Baba-God of peace go march Satan under hin leg.Make di grace of awa Oga Jesus Christ dey wit una.
21. Timothy my fellow hustler dey hail una, Lucius, Jason and Sosipater—wey be my fellow Jew; dem sef dey hail una.
22. Me, Tertius wey write dis letter for Paul—I dey greet una inside Christ.
23. Gaius wey dey host me and di full church, dey throway salute. Erastus wey be di treasurer of di city—dey greet una, plus awa broda Quartus—wey dey send una hin greetings.
24. Make di grace of awa Oga Jesus Christ dey wit una. Amen.
25. Make all di glory be to Baba-God wey fit make you strong kakaraka—based-on my good news and di message of Jesus Christ, based-on di deep- mata wey we don see—wey dey coded since Baba-God make di world,
26. but now e don show- face, and everi-pesin don know am tru di prophecy for di Holy-books wey di everlasting God command dem to write, so dat all nations go believe, and obey am.
27. All glory to di only wise God forever, tru Jesus Christ! Amen.