- Chai Baba-God, how many my enemies be sef? How many of dem wan change
am for me! Many of dem dey yarn me sey, “Baba-God no go fit save am.”
- But na you dey gaurd round me. Chai Baba-God, you just dey make my head
shine, con carry my head go up.
- Na Baba-God I dey raise my voice for, he dey ansa me from hin holy hill.
- I lie down sleep; con wakeup again, becos na you dey keep me alive.
- I no go fear di more dan ten thousand pipo wey wan fight me for every corners.
- Oh Bab-God arise! Save me, Oh Oghene. Nack all my enemies for jaw; brake
wicked pipo teeth.
- Na from Baba-God freedom dey from come. Make your blessings dey upon us
forever.
Post Views: 67