Psalm Chapter 4

Abeg share
  1. Ansa me wen I dey call you, Oh my righteous God.
    Cool me down from my wahala; sorry for me, make you hear my prayer.
  2. Oh men, how long una go dey turn Bab-God glory to mumu-tin? How long una
    go dey deceive unasef con dey fyne foriegn gods.
  3. I want make una know sey Baba-God don choose holy-pipo for hinsef; Baba-
    God go hear me wen I call am.
  4. No do bad becos you dey vex; wen you dey for bed, look inside your heart,
    make you dey quite.
  5. Offer di right sacrifices and trust Baba-God.
  6. Many pipo dey ask, “Who go fit show us any beta tin? Make di light wey dey
    your face shine upon us, O Lord.
  7. You don make my heart full wit jolly-jolly even pass wen dia food and drink
    brekete.
  8. I go lie down sleep wit peace, becos na only you dey save my life.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *