Psalm Chapter 29

Abeg share
  1. Make di mighty pipo tok sey Baba-God get glory and strength.
  1. Give Baba-God di glory wey fit hin name; worship Baba-God inside di beauty of
    hin Holliness.
  2. Baba-God voice dey ontop of waters; di God of glory dey halla like thunder,
    Baba-God dey halla like thunder ontp di ocean.
  3. Baba-God voice get power well-well, God voice dey royal.
  4. Baba-God voice fit break strong wood; Baba-God go break into pieces, di cedar
    of Lebanon.
  5. He go make Lebanon skip like nama pikin, and Sirion like young ox wey wild.
  6. Baba-God voice dey strike wit flash of lightening.
  7. Baba-God voice dey shake di desert; God dey shake di desert of Kadesh.
  8. Baba-God voice dey twist oaks, and hin voice fit fall all di tree for inside bush.
    And for inside hin temple everi-pesin go sing, “Glory!”
  9. Baba-God sidon for throne ontop of water; God dey for the throne as king
    forever.
  10. Baba-God dey give hin pipo strength; God dey bless hin pipo wit peace.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *