- I sey, “I go watch my ways con keep my tongue from sin; I go close mouth any
time wey badbelle pipo dey around me”
- But wen I dey silent and calm, and I no even yarn anytin good, my suffer-suffer
con burku.
- My heart don dey hot for my chest, and as I dey meditate, e be like sey the faya
dey burn more-more, I con tok wit my tongue:
- “Kukuma show me where my life go for end and how many more days I get for
dis earth, make I know as my life take be like breeze.
- You don make my days just like handbreath; di time wey I get for dis life na
nothing for you. Everi man life jut be like one single breath.
- As man dey waka upandan, hin life just be like sometin wey no dey exist for
where you dey. He just dey waste hin time dey denge-pose all about.
7.“But now Baba-God, wetin I dey fyne? My hope dey for you.
- Save me from all my big-big sins; no make mumu pipo dey laff me.
- I bin dey silent; I no gree open my mouth, na you do am.
- Carry your koboko comot from my side. The blow wey you give me don nack
me down.
- You yari for men con correct men becos of dia sins; you vanish dia wealth like
moth—everi man be like breath.
- “Hear my prayers Baba-God; make you hear my cry for epp, no close ears for
my cry. I dey your house like foreigner, like Jjc for as my papa-papa be.
- Carry your eyes comot from my body, so dat body go sweet before I comot
and I no go dey again.”
Post Views: 64