- Blessed na di man wey dey reason pipo wey no get power; na Baba-God dey
save am wen kasala burst.
- Baba-God go protect am and keep hin life; God go bless am for di land and
Baba-God no go let the bad tins wey badbelle pipo want make e happun to am,
happun to am.
- Baba-God go keep am wen hin sick ontop bed, con make am stand up from hin
sickbed.
- I sey, “Oh Baba-God, sorry for me; heal me, I don sin against you.”
- Wit badbelle, my enemies tell me sey, “Wen he go pkie and he name go
pkeme?”
- He dey lie for my head any time pesin fyne me come, he dey lie for my head, as
hin heart dey gather bad tins wey he wan yarn about me; naso he go go out con
start to dey do tatafo.
- All my enemies dey tok my mata small-small; dem dey imagine sey sometin bad
go happen to me. Dem sey,
8.“Evil disease don catch am; he no go fit ever stand up from di place wey hin dey
sleep.”
- Even my padi wey I trust, wey I dey follow me chop don change am for me.
- But you, Oh Baba-God, sorry for me; carry me up so dat I do make pay for
wetin dem do.
- I know sey you dey happy wit me, my enemies no go fit win me.
- You dey keep me inside my honesty.
- Prasie be to Baba-God, di God of Israel, from everlasting to everlasting. Amen
and Amen.
Post Views: 42