Psalm Chapter 47

Abeg share
  1. Clap una hand all di nations; shout to Baba-God wit cry of Joy.
  2. Baba-God wey be di Oga pkatapkata na ogbonge, nahin be di great king for di
    earth.
  3. He make nations obey us and he put pipo under our leg.
  4. Nahin dey choose awa inheritance for us, di pride of Jacob wey he love.
  5. Baba-God don ascend from inside di shout of Joy, and di Lord don ascend from
    di trumpet wey dey halla.
  6. Make una sing praises to Baba-God, make una sing, make una sing praises to
    awa king, make una sing.
  7. Na Baba-God be di king of all di earth, use psalm of praise sing for am.
  8. Baba-God dey reign over all di nations. Baba-God sidon for hin holy throne.
  9. Di bigmen of di nation gather together as di pipo of di God of Abraham. Na
    Baba-God nahin get di kings of di earth. Hin level high well-well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now