Psalm Chapter 63
- O Baba-God, na you be my God, I dey fyne you seriously; my soul wan drink you
like water, my body really want you, for land wey dry and for land wey no good,
where water no dey. - I don see you for inside your holy-place, I don see your power and your glory.
- Becos your love beta pass life, my lips go give you levels.
- I go praise you as long as I dey alive, and I go lift up my hand for your name.
- My soul go bellefull like pesin wey dey chop beta food, my lips go dey sing dey
praise you. - I go remember you ontop bed; I dey tink of you throughout di night.
- Becos na you dey epp me. Na under your wings I for dey sing.
- My soul dey hold you thight; your right hand hold me strong.
- God go scata those pipo wey dey fyne my life; dem go fall six feeth.
- Death go shuuk dem wit hin sword and dem go turn to food for jakals.
- But di king go happy for Baba-God; all those pipo wey dey swear wit Baba-God
name go praise am, as lie-lie pipo mouth go keep quite.
Questions about Psalm 63
What is Psalm 63 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 63 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-63/
Where can I read Psalm 63 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 63 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-63/
Which Bible book contains Psalm 63?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 63?
The chapter identified by this reference is 63.
Topics connected to this passage
- Love
- Strength
- Worship