- Sing new song for Baba-God, he don do elele tins; hin right hand and hin holy
hand don work salvation for am.
- Baba-God don make pipo know hin salvation and he don show di nations hin
righteousness.
- He don remember hin love and faithfulness for di house of Israel; all di end of di
world don see di salvation of awa God.
- Shout wit joy to Baba-God all di earth, start to dey freestyle and jirate wit beta
jamz;
- use di harp play music for Baba-God, wit harp plus beta voice,
- wit trumpet and sound of ram horn—shout wit joy for front of Baba-God di
Oba.
- Make di seas make noise plus everitin wey dey inside am, di world, and everi-
pesin wey dey stay there.
- Make di rivers clap dia hands, make di mountain sing together wit joy;
- make dem sing for Baba-God front, he dey come to judge di earth. He go judge
di world wit righteousness and di pipo wit hin church-mind.
Post Views: 70