Good health
Dis na popular Bible verses wey tok about good health:
3 John 1:2(Pidgin Bible) My love, I pray sey make you prosper, and live wit good health—even as your soul dey shine.
Exodus 15:26 (Pidgin Bible) He con tok sey, “If una go seriously listen to di voice of una Oga wey be Baba-God, and una go do wetin dey right for hin eyes, follow hin words, con keep hin law—I no go put any of dis disease for una body, wey I don put on di Egyptians, becos na me be Baba-God wey dey heal you.”
Proverbs 4:20–22 (Pidgin Bible) My pikin, turn your ears to wetin I dey tok, listen well-well to my words. No let dem komot for your eyes, keep dem inside-inside your heart; dem be life for those pipo wey see dem, plus good health for man full body.
Proverbs 3:7–8 (Pidgin Bible) For your own eyes, no see yoursef as pesin wey too get- sense; fear Baba-God and komot hand from evil tins. E go make your body get good health, and
make your bones strong kakaraka.
Proverbs 17:22 (Pidgin Bible) Heart wey dey jolly—dey do good like medicine, but spirit wey don taya—dey make bone dry.
Psalm 103:2–3 (Pidgin Bible) Praise Baba-God, Oh my soul, and make you no forget wetin you dey gain from am— Nahin dey forgive all your sins and heal all una diseases,
Psalm 107:20 (Pidgin Bible) He send hin word give dem and heal dem; hin rescue dem from grave.
Jeremiah 30:17 (Pidgin Bible) But I go give una good health again, con heal una wounds,” naso Baba-God tok, “Becos dem call you outcast, dem tok sey, ‘Zion wey no pesin care about.’ ”
Jeremiah 33:6 (Pidgin Bible) But time dey come wen I go heal my pipo and cure dia wounds, con give dem peace yanfu-yanfu plus truth.
Isaiah 40:29–31 (Pidgin Bible) He dey give pawa to pipo wey no-strong, and he dey give plenty pawa to pipo wey no get muscle.
Isaiah 53:5 (Pidgin Bible) But dem wound am becos of awa sins, dem beat am becos of di bad-bad-tin wey we dey do. He use hin head take carry di punishment wey give us peace; and we don heal by hin wounds.
Matthew 8:16–17 (Pidgin Bible) Wen evening reach, dem carry plenty pipo wey bad-spirit possess come meet Jesus, and he pursue all di spirit komot wit one single word, and he heal all di pipo wey dey sick. Dis one confam wetin Baba-God bin tok tru prophet Isaiah: “He carry awa sickness plus disease komot.”
Mark 5:34 (Pidgin Bible) He con tell her sey, “My daughter, your faith don heal you. Make you dey go in peace, and you no go suffer again.”
Luke 8:50 (Pidgin Bible) As Jesus hear dis one, he tell Jairus sey, “No let your mind cut; just believe, and she go heal.”
James 5:14–15 (Pidgin Bible) Abi any one of una dey sick? Make he call di senior-men of di church to pray for am, con anoint am wit ororo—in di name of di Oga. And di prayer wey dem pray wit faith go make di sick pesin dey alright; Baba-God go raise am up, and if di pesin don commit any sin, Baba-God go forgive am