Blog

Your blog category

  • Romans Chapter 12

    Living Sacrifice Love 9. Fashi fake love. Hate evil tin and hold wetin dey good. 10. Make una reason each oda mata wit love like brodas. And make una respect one anoda. 11. No dey lazy for business, but make your blood dey hot spiritually, as you dey serve Baba-God. 12. Use happiness take dey hope, dey patient wen you get wahala, and kontinu to always pray. 13. Share wit God-pipo wey need epp, and make una take care of unasef well-well. 14. Bless those pipo wey dey show you pepper, bless pipo and no curse dem. 15. Jolly wit those pipo wey dey jolly; cry wit pipo wey dey…

  • Romans Chapter 13

    Sempe For Di Leaders Love Na Di Koko Of Di Law 8. No owe any-pesin anytin—except to love one anoda, any-pesin wey love hin neighbour don do wetin di law want. 9. Di commandments nahin be dis, “No climb pesin husband or wife, no kill pesin, no steal, no lie for your neighbour head, no use ogboju,” and if any oda commandment dey, na di koko of all of dem be dis: “Love your neighbour as you take love yoursef.” 10. Love no dey do wrong tin to hin neighbour—so love na di koko of di law. 11. And do like dis; understand wetin dey happun. Time don reach wey…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now