Deuteronomy

  • Deuteronomy

    Deuteronomy Chapter 34

    Moses Kpeme For Mountain Nebo Naso Moses go up from di smooth-land of Moab, con go mountain Nebo, on top of Pisgah, wey dey for opposite Jericho. So Baba-God show am all di land of Gilead, far-far go reach Dan, di whole of Naphtali, plus di land of Ephraim and Manasseh, all di land of Judah, far-far go reach di  Big-river for di west [Mediterranean Sea], di south, plus di smooth-land wey dey for bottom-of- di-mountain of Jericho, di city of Palm Trees, far-far go reach Zoar. Naso Baba-God tell am sey, “Na dis be di land wey I swear to give Abraham, Isaac, plus Jacob, wen I tok sey,…

  • Deuteronomy

    Deuteronomy Chapter 33

    Moses Blessings For Israel Na dis be di blessing wey Moses wey be man of God  bless di pikins of Israel before he die. And he tok sey: “Baba-God come from mountain Sinai; he rise like sun on top of Edom, and he shine on hin pipo from mountain Paran. Ten thousand angels dey wit am, faya wey dey burn dey for hin right hand. Baba-God love hin pipo; all Hin holy-pipo dey for hin hand; dem dey bow down for hin leg. And dem dey obey hin words. Moses give us law, wey be special property of di pipo of Israel. Baba-God con be king for Jeshurun, wen di…

  • Deuteronomy

    Deuteronomy Chapter 32

           Moses Song “Hold you ear—oh heaven and I go tok. Oh earth, hear wetin my mouth dey yarn. My teaching go fall like rain, and my words go form dew for di earth. My words go fall like showers on top of young plants, like soft rain on top of grass: Becos I go praise di name of Baba-God, and hin  pipo go tok about how he great reach. “Na Baba-God be di Rock (defender), hin work dey  perfect, and all hin ways balance (na justice); na God of truth wey no get error, he dey do justice plus di right tins. “Dem don corrupt dem sef; dem no…

No copy from dis website