• Hosea Chapter 13

    Ephraim Levels Don Komot Baba-God Dey Vex 4. But na me be Baba-God wey be una Oga—ever since di land of Egypt; and make una no get any oda God apart from me, becos no god dey save apart from me. 5. I know una for inside desert, for land wey water no dey. 6. Wen dem con get green-land, naso dem belleful, dia hearts con dey feel-big, nahin make dem fashi me. 7. So I go attack dem like lion; I go hide like leopard for corner of dia road. 8. I go attack dem like bear wey dem tiff e pikin, and I go tear dia chest open.…