• Luke Chapter 11

    Jesus Teach About Prayers Ask, Fyne, Knock 5. He con tell dem one tori, “If to sey one of una get one padi, and you go meet am for midnight, con tok sey, ‘Aboki, biko epp me wit three bread, 6. becos one of my padi travel come see me, and I no get anytin to give am chop.’ 7. “Naso di one wey dey inside go ansa am sey, ‘No disturb me joor. Di door don already lock, and my pikin dey wit me for bed. I no fit stand up to give you anytin.’ 8. I dey tell una sey, he no go stand up to give am…

  • Luke Chapter 12

    Warning Against Fake-life Di Parable Of Di Rich Mugu 13. One pesin among di plenty pipo con tok am sey, “Teacher tell my broda sey make he share awa papa properties wit me.” 14. Jesus ansa di man, “Guy, who make me judge, or peace- maker for dis una mata?” 15. Jesus con tell dem sey, “Shine your eyes, make una guard unasef against all kain longatrot; No be di plenty properties wey man get nahin be hin life.” 16. Naso he tell dem dis parable: “One rich man harvest plenty fruits from hin farm. 17. He con reason wit hinsef sey, ‘Wetin I go do? I no get place…