Romans
-
1st Corinthians Chapter 16
Di Offering For God-Pipo 1. Now about di collection of moni for God-pipo: Do wetin I tell di Galatian churches to do. 2. For di first day of everi week, make all of una keep sometin—as Baba-God take bless una, so dat wen I show, una no go need to do any collection. 3. So wen I come, I go send di men wey una don confam wit una letter—to carry una gift go Jerusalem. 4. If e make-sense for me to go sef, dem go follow me go. Wetin I Want 5. I go come meet una—I go pass tru Macedonia [dey pass tru Macedonia]. 6. I fit even…
-
Romans Chapter 16
Greetings 1. I wan tell una beta tin about one of awa correct sista—Phoebe, wey be servant of di church wey dey for Cenchrea. 2. Make una receive her wit levels in Christ, wit di kain way dem take dey welcome God-pipo, and make una give her any kain epp wey she need from una. She don epp plenty pipo, even me sef. 3. Greet Priscilla, and Aquila—wey dey epp me inside Christ Jesus. 4. Dem don risk dia life becos of me. No be only me dey tank Baba-God for dem, but all di churches of di Gentile. 5. Still greet di church wey dey meet for dia house.…
-
Romans Chapter 15
Live To Make Odas Happy 1. We wey strong suppose epp those smesme pipo wey dey fall, and no be only to dey do wetin we like. 2. Everi-pesin suppose do good to hin neighbour to epp am—and to teach am. 3. Even Christ no do wetin go make hinsef happy, but as dem write am sey: “Di insult wey pipo insult you—dey for my head.” 4. Everitin wey dem don write before-before—dem write am to teach us, so dat we go fit get hope tru patience, and di moral wey di Holy-books dey give us. 5. Make Baba-God wey dey give endurance, and comfort, give una one mind among…