Romans
-
Romans Chapter 11
Di Remaining Pipo Of Israel 1. I ask now: Abi Baba-God fashi hin pipo? At-all-at-all! Me sef be Israelite, Abraham pikin-pikin-pikin, from di tribe of Benjamin. 2. Baba-God no fashi hin pipo wey he know from di beginning. Abi una no know wetin di Holy- Books tok about Elijah—how he complain to Baba-God about Israel: 3. “Baba-God, dem don kill your prophets con tear your altar put for ground; na me be di last man standing, and dem dey try to kill me”? 4. And wetin Baba-God ansa am? “I don keep seven thousand men for myself, wey neva bow down to Baal.” 5. As e be den, naso e…
-
Romans Chapter 10
1. Brodas and sistas, wetin my heart really want, and my prayer to Baba-God for di Israelite—na make dem get salvation. 2. I know di love wey dem get for Baba-God, but e no dey based-on di truth about Baba-God. 3. Since dem no sabi di goodness wey Baba-God dey give, and dem try to form dia own goodness by keeping di law; dem no gree for Baba-God goodness. 4. Christ na di end of di law, so dat goodness go dey for everi-pesin wey believe in Christ. Salvation For Everi-pesin 5. Moses write about di righteousness of di law; “Di man wey do dis tins go live by dem.”…
-
Romans Chapter 9
Baba-God Pesina Choice 1. I dey tell una di truth inside Christ, and I no dey lie, my conscience na my witness tru di Holy Spirit. 2. My heart dey feel sad wella, and I dey always feel pain for my heart. 3. I wish sey dem fit curse me komot from Christ, if na wetin go save my brodas and sistas wey be Jews. 4. Dem be di pipo of Israel. Na dem Baba-God choose as hin pikin; na dem Baba-God show hin levels, na dem Baba-God make agreement wit, na dem receive di law, di worship, and di promises. 5. Na dem get di ancestors wey Christ from…