Romans
-
Romans Chapter 2
Baba-God Good Judgement 1. Chai nnaa, so you wey dey judge anoda pesin no get any excuse, any way you take judge pesin, you sef dey condemn yoursef, becos you wey dey judge pesin—dey do di same tins. 2. We know sey Baba-God judgement against pipo wey dey do all those kain tins na based-on di truth. 3. Chai man, you dey reason dis tin, you dey judge pipo wey dey do those kain tins, and you still dey do di same tin, abi you tink sey you go fit dodge Baba-God judgement? 4. Abi you dey play wit hin kindness, tolerance, plus patience wey brekete, abi you no know…
-
Romans Chapter 1
1. Dis letter na from Paul, servant of Christ Jesus, wey Chineke choose to be apostle, and to preach di good news. 2. Baba-God promise di good news before-before, tru hin prophets for di Holy books, 3. about hin son, wey be David pikin-pikin-pikin, based-on hin human nature. 4. And tru di Spirit of holiness, Baba-God declare Jesus to be hin Son wit pawa—as he raise up from dead. 5. Tru Christ, Baba-God don give us grace, and we don be hin disciples, to call all world-pipo, to obey Baba-God wit faith—for hin name. 6. Unasef dey among pipo wey we call to belong to Jesus Christ. 7. I dey…