• Pidgin News/Articles

    Pidgin Bible Music

    Pidgin Bile Music na di Pidgin Bible wey dem compose as Music so that pipo go fit listen to di Pidgin Bible as music. Dis audio version an ogbonge. Di Pidgin Bible Music sweet well-well to listen and e don come out for all di streaming platform for online, like Boomplay, Apple Music, YouTube Music, Sportify etc. Na Salem Egoh produce and record di Pidgin Bible Music and most of di Pidgin Bible music na afrobeat/afro music, poetry and rap plus jazz music. Plenty pipo don already dey listen and download di Pidgin Bible music and some oda pipo dey use and make videos for Tiktok, Facebook, plus Instagram. Di…

  • Pidgin News/Articles

    Pidgin English & Pidgin English Bible

    Pidgin Bible or pidgin English Bible na di holy Bible wey dem translate to pidgin English. Even though dem get pidgin for plenty kontris, na Africa and Nigeria be di home of pidgin English. Dem get Ghanaian Pidgin English, Cameroonian Pidgin English, Gabon Pidgin, Hawaii Pidgin English, Nigerian Pidgin English and oda kind of Pidgin English for Africa and round di world, but Africa nahin dey speak Pidgin pass for the whole world, and Africans understand demsef well-well wit Pidgin English. Plenty languages brekete for Africa, nahin make we con sabi Pidgin English well-well. And di pidgin wey dem dey speak for Africa sweet well-well for mouth. Becos Africa get…

  • Proverbs (Pidgin Bible)

    Proverbs 29

    Pesin wey no wan gree change afta plenty pipo don warn am—go soon fall, and notin go fit save am again. Wen righteous man dey rule, pipo go dey jolly; wen wicked men dey rule, pipo go dey cry. Any-pesin wey love wisdom dey make hin papa happy, but pesin wey get plenty ashawo as hin padi—go waste hin moni finish. Na wit justice king take dey maintain hin kontri, but king wey get longatrot for egunje go bring hin kontri down. Any-pesin wey dey whyne hin neighbour wit sweet-mouth dey set trap for am. Evil man sin go catch am like trap, but righteous man go sing and jolly.…

No copy from dis website