Psalm Chapter 10
Dis Na Prayer For Justice
- Why you dey stand far-far Baba-God?
Why you dey throway-face wen kasala burst. - Wicked men dey feel-big as dem dey show poor pipo pepper. Make dem fall inside dia own evil plan.
- He dey make-mouth wit di bad tins wey
dey for hin mind; he dey bless pipo wey get
longatrot, and he fashi Baba-God. - Wicked pipo dey feel-big for dia
face—to fyne Baba-God; for hin
mind—Baba-God no dey. - He always dey succeed for hin ways, and
your judgement too high for am to see; as for
all hin enemies, he dey laff dem. - He dey tok for inside hin heart sey, ‘No-shaking for me; I no go ever face wahala.’
- Curses, wayo, plus mago-mago nahin
burku for hin mouth; palava plus sin dey
under hin tongue. - He dey wait codedly for inside di
villages; naso he waylay innocent
pesin—con kill am for secret place. He dey
watch poor pipo codedly wit bad-eyes. - He dey wait like lion wey dey hide esef
for hin zanga; he dey wait to catch poor pipo.
He dey catch poor pipo con draw dem enta
hin net. - He nack di pipo wey he catch, dem fall
for ground; dem fall under hin pawa. - He tell hinsef sey, “Baba-God don
forget, he don cover hin face, and he no dey
see again.” - Arise, Baba-God! Raise up your hand,
Oh Baba-God. No forget humble pipo. - Why evil man dey fashi Baba-God? For
inside hin heart, he dey tell hinsef sey,
“Baba-God no go ask us anytin!” - But you, oh Baba-God, you don see,
and you don observe di wahala plus
palava—and you go put am for your hand.
Di pipo wey no get epper dey put dia life for your hand; na you dey epp pipo wey no get
papa. - Break wicked man and evil man hand;
ask am about all di bad tins wey he don do,
until you no see any one again. - Baba-God na King forever and ever; di
nations don scata komot from hin land. - Oh Baba-God, you don hear wetin dey
for humble pipo mind, you go give dia heart
pawa, and you go open your ear to hear, - to do justice to pipo wey no get papa,
and pipo wey dem dey oppress—so dat di
men of dis earth no go dey oppress pipo
again.