Psalm Chapter 45
Dis Na Royal Wedding Song
- To di producer of music. Set am to “Di
Lilies.” Dis na Maskil of di sons of Korah. Na love song. My heart dey pour-throway wit some beta inspiration as I dey read my poem for di king; my tongue na di pen of writer wey sabi.
- Na you fine pass among men, beta words brekete for your lips.
So Baba-God don bless you forever. - Tie your sword for your body, Oh
jagaban! Dress up like king wey get levels. - Ride wit victory as king, for protecting
truth, humblesness and justice; and your right hand go teach you ogbonge tins. - Make your sharp arrow shuuk di heart of di king enemy, make di nations fall under your leg.
- Oh Baba-God your king-chair go last
forever and ever; staff of justice nahin be di staff of your kingdom. - You love right tins, and you hate
wickedness; so Baba-God wey be your God don anoint you wit di ororo of happiness, con make you happy—pass all your padi. - Scent of myrrh, and aloes, plus
cassia—nahin dey for all your cloth; from palace wey dem design wit ivory, wey don make body sweet you. - King daughters dey among your women wey dem respect; di queen stand for your right hand—she dress up wit gold from Ophir.
- Oh daughters, make una calm down, and listen to me: Forget your pipo and your papa house.
- So di king go seriously want you as you fine; worship am, becos na your Oga.
- Di daughter of Tyre go carry gift come, di bigmen among una go fyne your favour.
- Di princess dey shine for di palace; na
gold dem use weave her gown. - Na dress wey get plenty colours she go wear—wen dem wan carry her go meet di King; her friends wey be virgins—go follow her, and dem go come meet you.
- Naso dem go come wit jolly plus
happiness—dem go enta di king palace. - Your sons go become king like dia papa, you go make dem princes for all di earth.
- I go make pipo remember your name for all generations; so di pipo go cut-cap for you forever and ever.