Psalm Chapter 51
Make Clean Heart Dey Inside Me,
Oh Baba-God
- To di chief musician. Dis na Psalm of
David—wen Nathan di prophet go meet am, afta he sleep wit Bathsheba. Chai Baba-God,
sorry-for me based-on your soft- love;
komot my sins based-on how you dey sorry-for pesin well-well. - Wash all my sins komot wella, and clean my sins komot.
- I know sey I don commit sins, and my
sins always dey for my front. - Na against you, na only you I don sin
against, and I don do evil tins for your front, so dat you go dey right wen you tok, and make you dey correct wen you judge. - True-true, my mama born me inside sin, and na inside sin my mama take carry me for belle.
- True-true, you wan make truth dey
inside me, and you go teach me wisdom deep inside me. - Clean me wit hyssop, and I go dey clean; wash me, and I go white pass snow.
- Make me hear joy and happiness; so dat my bones wey you don break fit dey happy.
- Carry your face komot from my sins, and komot all my sin.
- Make pure heart dey inside me, oh Baba-God, and ginger new correct spirit inside me.
- No pursue me komot from your front, or carry your holy spirit komot from me.
- Give me back di happiness wey I get wen you first save me, and make me stand for you wit free spirit to obey you.
- Den I go teach sinners about your ways, and sinner go change—con dey follow you.
- Oh Baba-God, di God wey dey save me, forgive me becos my hand stain wit blood of men, and my tongue go sing loud song about di correct tins wey you dey do.
- Oh Baba-God, open my lips, and my
mouth go praise you. - No be sacrifice dey make body sweet
you—or I for give you; body no dey sweet you for burnt offering.
- Di kain sacrifice wey Baba-God
want—na humble spirit, oh Baba-God you no go reject humble heart wey ready to repent. - Make body sweet you to prosper Zion;
build di walls of Jerusalem. - Naso di correct sacrifice go make body sweet you—wit burnt offering, plus full burnt offering; and naso dem go give mal for your altar.