Psalm Chapter 66
Praise Plus Tanks-giving
- To di chief musician. Dis na song. Na
Psalm. Make una shout wit happiness to Baba-God—all di earth! - Sing about di levels of hin name; cut-cap for am wit praises!
- Tell Baba-God sey, “Your handwork na
elele! Your pawa great well- well— sote your enemies go surrender demsef to you. - Everi-pesin for di earth go worship you, and dem go sing to you; dem go sing praise to your name.”
- Come see wetin Baba-God don do, see di ogbonge work wey he do for pipo!
- He turn big-river [sea] to dry land, dem
use leg pass tru di water—we happy for wetin he do for there. - He dey rule forever wit hin pawa, hin
eyes dey observe di nations—no let pipo wey dey rise against you—carry-shoulder-up. - Oh pipo, make una bless awa God, and raise your voice to praise am.
- He dey keep awa life among di living,
and he no gree let us fall. - You, Oh Baba-God, you don test us; you don make us pure like silver.
- You carry us enta trap, con put heavy
load for awa back. - You allow men march awa head; we pass tru faya and water, but you carry us enta place wey brekete wit good tins.
- I go come your worship-place wit burnt offerings, I go pay my promises to you—
- promises wey my lips yarn, and wey my mouth tok wen wahala hook me.
- I go sacrifice animal wey be ororbor—to you, wit sweet scent of ram; I go give you plenty malu plus goats.
- Make una come hear—all of una wey
dey fear Baba-God; I go tell una wetin he don
do for my soul. - I cry to am wit my mouth, and I praise am wit my tongue.
- If to sey I carry sins inside my heart, Baba-God for no hear me.
- But Baba-God don surely listen, con hear my voice wen I pray.
- Praise be to Baba-God, wey neva fashi my prayer, or stop to sorry-for me!