Psalm Chapter 72
Prayer For Di Oba [King]
- Dis na Psalm of Solomon. Oh Baba-God, give di king your justice, and give di king pikin [prince] your goodness.
- He go judge your pipo in di right way,
and poor pipo wit justice. - Di mountain go bring alafia [peace] to di pipo, and di hills go bring goodness.
- He go give justice to di pipo wey dey
suffer among di pipo, he go save di pikin of pipo wey need epp, and he go scata di oppressor to pieces. - Dem go fear you as long as di sun and moon dey for all generations.
- Make di king be like rain wey dey fall for farm wey dem don clear, like showers wey dey water di land.
- Good man go prosper for hin life wit
peace wey brekete—as long as di moon dey shine. - He go rule from big-river to big-river,
and from di river [ river Euphrates]—to di end of di earth. - Di tribes for inside di desert go bow
down for hin front, and hin enemies go lick dust. - Di king of Tarshish, plus kings of di
islands go bring gifts; di kings of Sheba and Seba go carry gift come meet am. - Yes, everi king go dobale for am, and all nations go serve am.
- He go save poor pipo wey dey cry to am, pipo wey dey suffer- suffer, and pipo wey no get pesin to epp dem.
- He go epp poor pipo and pipo wey no get shi-shi, and he go save di soul of pipo wey need epp.
- He go save dem from oppression, and from anytin wey go wound dem, and he no go use dia blood play.
- And He go live long. Dem go give am gold from Sheba. Pipo go always dey pray for am, and dem go praise am everi day.
- Food go yanfu-yanfu for di earth, make food brekete on top of di hills. Make di fruit trees grow like di trees of Lebanon; and make di pipo prosper for di cities—like grass of di earth.
- Hin name go last forever, hin name go kontinu as long as di sun dey shine. He go make all nations prosper, and dem go call am blessing.
- Praise Baba-God di Oga, di God of Israel—na only am dey do ogbonge tins.
- Praise be to hin name wey get levels forever! Make di whole earth burku wit hin levels. Amen! Iseee!
- Dis na di end of di prayers of David—Jesse pikin.