Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 77

Abeg click here to share dis post

Na Baba-God Dey Cool Pesin Down

  1. To di Chief producer. To Jeduthun. Dis
    na Psalm of Asaph. I cry to Baba-God wit my voice. I cry to Baba-God wit my voice—and he hear me.
  2. I fyne Baba-God, wen I dey inside
    wahala; tru-out di night I stretch my hand to pray, and I no taya. My soul no gree cool down.
  3. I remember Baba-God, and I cry; I
    complain, and my spirit con dey weak.
  4. You no let my eyes close; my wahala
    burku—sote I no-fit tok.
  5. I con reason olden days, and di life of
    before-before;
  6. I remember my song for night, I meditate for my heart, and my spirit dey fyne you seriously:
  7. “Shwoo..Abi Baba-God wan fashi me
    forever? Abi he go fit show us hin favour again?
  8. Abi he don stop to sorry-for
    pesin forever? Abi hin promises don fail forever?
  9. Abi Baba-God don forget to show us hin grace? Abi he don use vex stop to sorry-for us wit jeje?”
  10. I con tok sey, “Dis na my wahala; but I go remember di year of di right hand of di Oga kpatakpata.”
  11. I go remember wetin Baba-God don do; Yes, I go remember di miracles wey you don do tey-tey.
  1. I go meditate on all your works sef, con tok about your works.
  2. Oh Baba-God, your ways dey holy,
    which god great like awa God?
  3. Na you be di God wey dey perform
    miracle; you show your pawa among di pipo.
  4. You don use your big hand take save
    your pipo, di sons of Jacob plus Joseph.
  5. Oh Baba-God, di Red sea see you, di
    water see you—con dey fear; di big-river wey deep con dey shake.
  6. Rain pour from di clouds, di heavens
    sound wit thunder; your arrow of lightning dey flash.
  7. Dem hear your thunder inside di rolling-breeze, your lightning light up di world. Fear catch di earth, and di earth con dey shake.
  8. Your road pass tru di big-river, your
    ways pass tru big-big water, and no-pesin sabi your steps.
  9. You use Moses and Aaron hands take
    lead your pipo as shepherd take dey lead sheep.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website