Psalm Chapter 78
Baba-God Love Hin Pipo
- Dis na Maskil of Asaph. Oh my pipo,
make una hear wetin I dey teach una; listen to di words wey dey komot from my mouth. - I go open my mouth wit parables, I go tok plenty coded yarnings from olden days—
- tins wey we don hear, and wey we
know—wey awa papa don tell us. - We no go hide dem from awa pikin; we go tell di next generation about di praises of Baba-God, about hin pawa and hin ogbonge works wey he don do.
- He give di law to Jacob, and he put law down for Israel—wey he tell awa ancestors to teach dia pikin,
- so dat di generation wey go come go sabi dem, even di pikin wey dem neva born go rise—con tell dia pikin sef.
- Make dem put dia hope on Baba-God,
and make dem no fashi all di tins wey Baba-God don do, but make dem keep hin commandment; - and dem no go be like dia papa-papa-papa—generation wey get coconut-head and wey no gree hear-word, wey no put dia heart straight, and wey dia spirit no dey follow Baba-God.
- Di children of Ephraim turn back, even wit dia weapon and bows—for di day of war.
- Dem no gree keep Baba-God agreement,
and dem no gree obey Baba-God law. - Dem forget wetin Baba-God don do, di
miracles wey he don show dem. - He do great miracles for dia papa
front—for di land of Egypt, for di fields of Zoan. - He divide di big-river, con carry dem
pass tru; he make di water stand up like wall. - He guide dem wit di cloud for day, and
wit di light of faya for night. - He break di rock for desert, con give dem plenty water like big-river;
- He make streams flow komot from rock, con make water flow like rivers.
- But dem con dey commit sin more-more against Baba-God, becos dem no gree follow di word of Baba-God Most High—for inside desert.
- Dem test Baba-God for dia heart—by
asking for food wey dem wish for. - True-true, dem bad-mouth Baba-God,
dem tok sey, “Abi Baba-God fit arrange table for us for inside desert? - Wen he nack di rock, water rush come
out and stream flow brekete. But he go fit give us food sef? He fit give hin pipo meat?” - Baba-God hear dem, naso he vex well-well, hin faya change-am-for Jacob, and he para for Israel,
- becos dem no gree believe Baba-God, or trust sey Baba-God go save dem.
- Upon dat, he command di cloud for up, and he open di door of heavens;
- manna fall from heaven like rain—so dat hin pipo go chop, he give dem food from heaven.
- Men con dey chop angel food; he give
dem enuff food to make dem belleful. - He make di east breeze blow for di
heavens, and by hin pawa, he bring di south breeze. - He make meat drop from heaven like
dust, fawo wit feather wey plenty like sand-sand for beach. - He make di fawo fall around dia camp, and round where dem dey stay.
- Dem chop—con belleful, and he give
dem wetin dem want. - He no stop to give dem dia
wish, but even wen di food still dey for dia mouth, - naso Baba-God vex for dem; he kill dia strongest men, con cut down di best men of Israel.
- Upon all dis, dem still kontinu to dey sin, and dem no gree believe di ogbonge works of Baba-God.
- So he waste dia life, and dem live dia life wit fear.
- Any time wey Baba-God kill dem, dem
go con dey fyne am; dem go con
serious—rush go meet am again. - Dem con remember sey na Baba-God be dia rock, and sey na di Most High God dey save dem.
- But dem con whyne am wit dia sweet-mouth—and dem lie to Baba-God wit dia tongues.
- Dia heart no gree obey Baba-God, and
dem no dey faithful to hin agreement. - But becos of hin soft-heart, he forgive
dia sins, and he no dabaru dem. Many times, he stop to dey vex for dem, and he no para for dem. - He remember sey dem just be flesh, like breeze wey dey blow dey go—and wey no dey come back.
- Plenty-plenty times dem provoke am for inside di desert, and dem make am vex for inside di desert!
- Everi time, everi time, dem test Baba-God, and dem use small- eyes take look di Holy One of Israel.
- Dem no remember hin pawa—and di
day wey he save dem from dia enemy— - di day wey he show hin miracle signs for Egypt, and hin wonders for di fields of Zoan.
- He turn dia river to blood, plus dia
streams—sote dem no-fit drink from am. - He send plenty flies wey chop dem, plus frogs wey scata dem.
- Baba-God send grasshopper to chop dia plants, and locust chop wetin dem produce.
- He dabaru dia plants wit ice- stone, and dia fig trees wit plenty-water.
- He use ice-stone nack dia malu, and
lightning strike dia animals. - He change-am-for dem like faya; as he para, wit vex, plus kasala—by sending angels wey dey scata-scata among dem.
- He prepare road for hin vex, and allow
death swallow dem, and he let disease nack dem. - He kill all Egypt first born, di best of dia young men for di land of Ham.
- But he carry hin pipo come out as
shepherd dey lead sheep, he carry dem like sheep pass inside desert. - He guide dem safely—sote fear no catch dem, but water carry dia enemies go.
- Naso he carry dem reach di border of hin Holy land, to one mountain wey hin right hand don choose.
- He pursue nations komot from dia front, con give dem di land as dia own; he settle di tribes of Israel for dia tent.
- But dem con dey test Baba-God, dem con dey provoke Baba-God, wey be Oga kpatakpata; and dem no gree follow hin word.
- Like dia papa, dem turn back wit unfaithfulness, dia way con bend like bow wey don kpafuka.
- Dem make am vex wit di shrine wey dem build for oda gods, and dem make am jealous—wit dia idols wey dem carve.
- Wen Baba-God hear dem, naso vex catch am; he con reject Israel kpatakpata.
- He fashi di worship-place of Shiloh; di place wey he dey stay among men.
- He let enemies catch hold hin pawa, and hin levels enta hin enemies hand.
- He let enemies kill hin pipo wit sword; he vex well-well for di pipo wey belong to am.
- Faya burn dia young men, and dia young babes no-fit marry.
- Dem kill dia priests wit sword, and dia widows no-fit cry.
- Naso Baba-God con wake up—like sey he bin dey sleep, like strong man wey dey shout becos he don high.
- He beat hin enemies back; he make shame catch dem forever.
- Naso he fashi di house of Joseph, and he no gree choose di tribe of Ephraim;
- but he choose di tribe of Judah, Mount Zion wey he love.
- He build hin holy-place as high as di heavens, like di earth wey he stand gidigbam forever.
- He choose David hin servant, con carry am from sheep-house;
- from taking care of sheep—to be di leader of hin pipo—Jacob, and Israel—wey belong to am.
- And David lead dem wit hin clean-heart, and he guide dem wit hin hand wey get skill.