Psalm Chapter 79
Sadness On Top Jerusalem
- Dis na Psalm of Asaph. Chai Baba-God,
di nations don take over your land; dem dondey spoil your holy worship-place, dem don scata Jerusalem for ground finish. - Dem don carry your servants deadbody—give birds wey dey fly for sky, dem don carry di flesh of your holy- pipo—give wild animals of di earth.
- Dem don pour your servants blood like water, all around Jerusalem, wit no-pesin to bury dem.
- Awa neighbours dey yab us, those pipo wey dey around us dey use us play, and dem dey laff us.
- 5. Oh Baba-God, how long you go dey vex forever? How long your jealousy go dey burn like faya.
- Para for di nations wey no gree know you, and for di Kingdoms wey no gree call your name.
- Dem don scata your pipo—Jacob, and dem don scata di place wey you dey stay.
- No use di sins wey we commit before-before take judge us. Sorry-for us kiakia, becos we dey low-key.
- Epp us, Oh Baba-God awa Saviour, for di glory of your name. Free us, and forgive us awa sins—becos of your name!
- Why di nations go dey tok sey, ‘Where dia God dey sef?’ For front of awa eyes, show yoursef among di nations-sey you dey revenge di blood of your servants wey dem shed.
- Baba-God, hear di cry of prisoners; use your big pawa take save pipo wey dem don sentence to death.
- Oh Baba-God, pay back seven wey dem yab you. times to awa neighbours, all di yab
- So dat we wey be your pipo, and di sheep of your green-land—go always tank you forever. And we go praise you from generation to generation.