Psalm Chapter 85
Call Upon Baba-God To Sorry-for
Us
- For di producer of music. Dis na Psalm of di son of Korah. Oh Baba-God, you don favour your land; you don bring back di prisoners of Jacob.
- You don forgive di wrong tins wey your pipo do, con cover all dia sins.
- You don stop to dey vex for dem, you don turn from your serious vex.
- Oh Baba-God save us again, and stop to dey vex for us.
- Abi you wan vex for us forever? Abi you wan vex for us for all di generations?
- Abi you no go ginger us again, so dat
your pipo go happy becos of you? - Sorry-for us, oh Baba-God, and give us
your salvation. - I go listen to wetin Baba-God di Oga go tok; he go promise peace to hin pipo, plus hin holy-pipo—but make dem no do mumu tins again.
- True-true, hin salvation dey near pipo wey dey fear am, so dat hin glory go dey for di land.
- Mercy plus truth don jam togeda, goodness plus peace don kiss each oda.
- Truth go show-face from di earth, and goodness go look down from heaven.
- Baba-God go true-true give una beta tins, and awa land go produce e harvest.
- Goodness go dey for Hin front, and e go make Hin steps—awa way.