Psalm Chapter 90
Baba-God Dey Forever
- Dis na prayer of Moses wey be Baba-God man. Baba-God, e don tey wey you be awa house, for all generations.
- Before you make di mountains, or even before you make di earth, plus di world, and even from everlasting to everlasting na you be Baba-God.
- You dey turn men back to dust, and you dey tok sey, “Oh man pikin, go back to dust,”
- One thousand years for your eyes—just be like yesterday wen e pass, or like four hours for night.
- You sweep dem komot like plenty-water; dem be like sleep. For morning, dem be like grass wey dey grow.
- E dey grow for morning and e dey shine, but before evening—dem don cut am down, and e go dry finish.
- We dey kpeme as you dey para, and we dey shake as you dey vex.
- You don put awa sins for your front, awa coded sins dey for di light wey dey shine for your front.
- All awa days dey waka go as you dey vex for us, and we dey spend awa life like tori wey dem dey gist.
- Awa life no pass seventy years—if we
get pawa reach—eighty; on top of dat, na only hustle, plus wahala pipo fit use make-mouth. Awa days go pass sharp-sharp, and we go fly komot. - Who sabi di pawa of your vex? Your vex big like di fear wey pipo get for you.
- Teach us how to count awa days, so dat awa heart go sabi wisdom.
- Oh Baba-God, come back to us! How
long? And show your servant your soft-heart. - Make us belleful early wit your mercy,
so dat we go fit celebrate, and dey happy all awa life! - Make us jolly reach di numbas of days wey you don punish us, replace di evil days wit good times.
- Make your work show-face to your
servant, and make your glory dey on dia pikin. - Make di beauty of Baba-God awa Oga—dey upon us, and make awa business stand—yes, make awa business stand.