Psalm Chapter 91
For Baba-God Hand
- Pesin wey dey stay under di coded place of di Most High, go rest under di shadow of di Oga kpatakpata.
- I go tok about Baba-God, “Nahin be my strong-house, and nahin I dey hide my head put; na my God wey I trust.”
- True-true he go save you from di trap of di hunter, and from bad-bad disease.
- He go use hin feather cover you, and you go hide your head under hin feathers. Hin truth go be your guard and protection.
- You no go fear di wahala for night, or di arrow wey dey fly for day,
- or di bad-bad disease wey dey waka for darkness, or di kasala wey dey burst for day time.
- One thousand pipo fit fall for your side, and ten thousand for your right hand, but e no go come near you.
- You go only see am wit your eyes, con
see as Baba-God go take punish evil pipo. - Becos you don make Baba-God your
protection, and you dey live inside di Most High, - evil tin no go reach where you dey stay, and no bad disease go come near your house.
- He go put hin angels to take care of you, to guard you for all your ways.
- Dem go carry you wit dia hand, so dat
you no nack your leg for stone. - You go march on top lion and cobra; you go march young lion, plus snake under your leg.
- “Becos he don love me, so I go save am, I go carry am go up—becos he don sabi my name.
- He go call me and I go ansa am; I go dey wit am for inside wahala. I go save am—con honour am.
- I go make am belleful wit long life, and I go show am my salvation.”