2nd Corinthians

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 10

    Paul Defend Hin Work 1. Wit di softness and jeje of Christ, me, Paul—dey beg una. I dey lowkey wen I dey wit una, but I get full-mind wen I no dey around una! 2. So, I dey beg una now, so dat wen I land, I no go show mysef wit full-mind against some pipo wey tink sey we dey live based-on di world level. 3. Even though we dey live for di world, we no dey fight war as world pipo take dey fight. 4. Di weapons wey we dey use dey fight war—no be di weapons of dis world. Instead, dem be ogbonge tru Baba-God—to bring down…

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 9

    Giving Wit Open Heart 1. Now about una service to God-pipo, I no need to write to una. 2. I know as una dey serious well-well to epp, and I don dey use am dey make-mouth for Macedonia—I dey tell dem sey since last year, una wey dey for Achaia—ready to give; and di moral wey una get, don make most of dem do am. 3. But I dey send di brodas, so dat we no go just dey use una make-mouth for notin based-on dis mata, but make una dey ready, as I don tell dem, 4. so dat if any-pesin from Macedonia follow me come, con see sey…

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 8

    Make Una Give Wit Open-heart 1. And now, my brodas, we wan make una know about di grace wey Baba-God don give di churches for Macedonia, 2. sey for inside dia temptation of serious palava, dia happiness wey brekete and dia konk poverty—dem dey give plenty, wit open heart—based-on wetin dem get. 3. I dey tell una sey dem give as dem fit give reach, dem even give pass dia pocket, and dem do am wit dia free mind, 4. dem beg us seriously to follow us share inside di service to epp God-pipo wit gifts. 5. And dem do pass wetin we expect. Dem first give demsef to Christ,…

No copy from dis website