2nd Corinthians
-
2nd Corinthians Chapter 7
1. My love, since we don get all dis promises, make we clean awasef from everitin wey dey spoil awa body and spirit, and make we use di fear of Baba-God take make awa holiness perfect. Happiness Wey Paul Get 2. Open your heart to us. We neva offend any-pesin, we neva corrupt any-pesin, we neva play any-pesin wayo. 3. I no dey tok all dis tin to condemn una; I don tok am before sey, una dey inside awa heart—to die and live wit una. 4. I don follow una tok wit full mind; I dey use una make- mouth well-well. Una don ginger me, and I dey happy…
-
2nd Corinthians Chapter 6
1. So, as pipo wey dey hustle for Baba-God togeda, we dey beg una—make una no collect Baba-God gift—con waste am. 2. He tok sey, “For time wey I ready to accept una, I hear una, and for di day of salvation, I epp una.” Baba-God don ready to accept una now. Today-today na di day of salvation. Paul Suffer-head 3. We no dey offend any- pesin in any way—so dat pipo no go bad-mouth awa work. 4. Instead, for everitin, we dey confam awasef as servant of Baba-God; inside serious patience, wahala, suffer-head plus yawa, 5. wen dem beat us, wen we dey inside prison—inside katakata, hard work, nights…
-
2nd Corinthians Chapter 5
Awa Heavenly House 1. Now we know sey, if di house wey we dey stay for dis earth scata [dat mean sey, wen we die and we komot from dis body], we get house from Baba-God, body wey dey last forever for heaven—wey Baba-God make for us. 2. We dey cry inside dis awa body, and we really wan wear awa heavenly body, 3. becos wen we wear awa heavenly body, we no go be spirit wey no get body. 4. We wey dey inside dis human body dey cry, and we dey feel di weight, no be sey we wan kpeme so dat we go fit komot from dis…