2nd Corinthians

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 4

    Beta-beta-tins For Inside Clay Pot 1. So, as e be sey na wit Baba-God mercy we take get dis ministry, awa mind no dey cut. 2. But, we don reject those secret yama-yama ways; we no dey play pipo wayo, or handle Baba-God word wit wuru-wuru. Instead, Baba-God na awa witness sey we dey show di truth, so dat odas go dey sure sey dem fit trust us. 3. And even if awa good message dey covered, e dey covered to those pipo wey don lose, 4. and di god of dis world, don blind di mind of pipo wey no gree believe, if not di light of di good…

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 3

    1. Abi we don start to dey praise awasef again? Like some pipo, abi we need to write to una about awa levels, or ask una to write about awa levels? Shwoo! 2. Na una be awa letter—wey dey awa heart, wey everi-pesin don know, and wey dem don read. 3. Una don show sey una be letter from Christ, na una be di result of awa work. Dis letter no be letter wey dem write wit ink, but na wit di Spirit of di living God. Dem no write am on top of stone, but na for di wall of man heart dem write am put. 4. Na dis…

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 2

    1. So I decide for my heart sey I no go come meet una again wit sadness. 2. If I make una feel sad, who go remain wey go make body sweet me, apart from una wey I don already make to feel sad? 3. I dey write dis very tin to una—so dat wen I show, I no go get palava wit pipo wey suppose make body sweet me, and I get full-mind for all of una—sey wen I dey happy, una sef go happy. 4. I dey write to una wit serious palava, and wahala for my heart, and wit plenty tears, no be to make una feel…

No copy from dis website