Jonah

Jonah Chapter 2

Abeg click here to share dis post

Jonah Prayer

  1. From inside di fish belle, Jonah pray to hin God wey be hin Oga.
  2. He tok sey: “Na from inside my wahala I take I call Baba-God, and he ansa me. From deep inside grave, I call for epp, and you listen to my cry.
  3. You throway me inside deep-deep water, inside di belle of big-water, and di waves round me; all di water wey dey roll plus di waves, round me.
  4. Naso I tok sey, “Chai Baba-God, you don pursue me komot from your face; but I go look your holy worship-place again.’
  5. Di water swallow me—e even cover my soul, di deep water surround me; grass for inside water wrap my head.
  6. I sink reach ground, to di root of di mountains; di sand-sand wey dey under di water hold me forever. But you carry my life komot from inside di pit, Oh Baba-God my Oga.
  7. “Wen my life dey fade komot, I remember you, Baba-God, and my prayers rise to you, e rise go your holy worship-place.
  8. Those pipo wey dey follow useless idols, dey fashi Baba-God love for dem.
  9. But I go sacrifice to you wit song of tanks-giving. I go pay wetin I don promise you. Na Baba-God dey save pesin.”
  10. Naso Baba-God tok to di fish, and di fish vomit Jonah for dry land.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website