Acts

  • Acts

    Acts Chapter 28

    Near Land For Malta 1. As we reach land safely, we notice seydem dey call di island Malta. 2. Di pipo wey dey stay di island show usbeta kindness. Dem build faya, and demwelcome all of us, becos rain dey fall andcold dey. 3. Paul gada some wood and as he dey putam for faya, one viper snake wey di heatpursue komot from di wood—con tie Paulhand. 4. Wen di pipo wey dey stay for di islandsee di snake dey hang for hin hand, dem con dey yarn demsef sey, “Dis man must be killer; even though he don escape from water, justice no wan gree make he dey alive.”…

  • Acts

    Acts Chapter 27

    Paul Follow WaterGo Rome 1. Wen dem decide sey we go move wit boat go Italy, dem carry Paul and some oda prisoners give one Roman officer wey dem dey call Julius, he belong to di Royal Army. 2. We enta ship from Adramyttium, for di coast around Asia, and we suppose stop for different ports along di coast for di area. Aristarchus wey be Macedonian from Thessalonica dey wit us. 3. Di next day, we land for Sidon; and Julius show Paul kindness, he allow am go meet hin padi, so dat dem go fit provide for wetin he need. 4. From there, we enta water again, and we…

  • Acts

    Acts Chapter 26

    Paul Defend Hinsef For Agrippa Front 1. Agrippa con tell Paul sey, “You get permission to tok for yoursef.” So Paul give dem sign wit hin hand, con start to dey defend hinsef: 2. “King Agrippa, na beta tin for me—sey I stand for your front today as I dey defend myself for di mata wey di Jews dey carry put for my head. 3. And naso, becos you know di Jews tradition well-well, and matas wey tie-wrapper. So I dey beg you make you hear me wit patience. 4. “Di Jews know di way I dey live—ever since wen I be small pikin, from di starting of my life…

No copy from dis website