Romans
-
Romans Chapter 14
Why You Dey Judge Your Broda? 1. Accept pesin wey get weak faith, and no argue wit dem about tins wey dem tink sey dey right or wrong. 2. For example, one pesin believe sey e fit chop everitin, but anoda man wey no get strong faith dey chop only vegetable. 3. Make di man wey dey chop—no hate di man wey no dey chop. And make di man wey no wan chop, no judge di man wey dey chop. Baba-God don accept am. 4. Who be you to dey judge anoda pesin servant? Na hin oga go tok if he dey right or wrong. And he go stand, becos…
-
Romans Chapter 13
Sempe For Di Leaders 1. Everi-pesin must obey di leaders. No pawa dey except na pawa Baba-God. And Baba-God nahin put leaders for dia position. 2. Any-pesin wey no obey leaders, dey disobey wetin Baba-God don stand, and those pipo wey do like dat—go receive punishment. 3. Govment, no dey attack pipo wey dey do di right tin, but na those wey dey do evil. If you wan free from govment wahala? Do di right tin, and dem go honour you. 4. Govment be like Baba-God servant wey suppose do beta tin for di pipo. Make fear catch you if you do evil, becos leaders get di pawa to punish…
-
Romans Chapter 12
Living Sacrifice 1. My pipo, becos of how Baba-God take sorry-for una reach, I dey beg una to give una body as sacrifice wey get life, wey holy, and wey dey sweet Baba-God—dis na di service wey make sense. 2. No dey follow di pattern of dis world, but upgrade yoursef by changing your tinking, so dat you go fit confam wetin dey good, and wetin Baba-God go accept, plus Baba-God perfect wish. 3. I sey, tru di grace wey Baba-God don give me to everi- pesin among una: make no-pesin reason hinsef pass di level wey e dey, but make e reason hinsef seriously, based-on di level of faith…