Romans
-
Romans Chapter 8
Life Tru Di Spirit 1. Now, we wey belong to Christ Jesus no go face any punishment—we wey no dey run tins based-on wetin awa body dey feel, but based-on di Spirit. 2. Becos di law of di Spirit of life inside Christ Jesus—don free me from di law of sin plus death. 3. Wetin di law of Moses no bin get pawa to do, becos sin don make am no-strong again, nahin Baba-God do, by sending hin own Son like man wey dey commit sin, as sacrifice for sin. Naso he condemn sin for inside man body. 4. He do am so dat we wey no dey live based-on…
-
Romans Chapter 7
Explanation from Marriage 1. Brodas and sistas wey know di law, una no know sey di law get pawa over pesin—wen di pesin dey alive? 2. For example, di law tok sey—married woman go dey wit her husband as long as he dey alive, but if her husband kpeme, di law don free her from dat marriage. 3. If she go marry anoda husband wen her husband still dey alive, dem go call her ashawo. But if her husband die, she don free from dat law. And she no be ashawo, even though she marry anoda man. 4. So my brodas and sistas, you sef don kpeme for where di…
-
Romans Chapter 6
Dead To Sin And Alive Inside Christ 1. Wetin we go tok now? Abi make we kontinu to dey commit sin so dat Baba-God grace go brekete? 2. Lai-lai! We don kpeme for where sin dey; how we go con live inside sin again? 3. Abi una no know sey all of us wey baptize enta Christ Jesus don baptize enta inside hin death? 4. E mean sey dem bury us wit Christ tru baptism—enta inside hin death, so dat as Christ take raise up from di dead tru di levels of di Fada, we sef go waka inside new life. 5. If we don gum-body wit Christ like dis—inside…