Romans
-
Romans Chapter 5
Peace Plus Happiness 1. So, as we don get pure-heart tru faith, we get peace wit Baba-God tru awa Oga Jesus Christ. 2. Na tru Christ we take get connection by faith, to enta dis grace wey we dey stand put, and we dey happy inside di hope of di levels of Baba-God. 3. No be only so, but we still dey jolly inside awa suffer- head, becos we know sey suffer- head go make us get patience, 4. and patience go give us character, and character go bring hope. 5. And hope no fit disappoint us, becos Baba-God don pour hin love inside awa heart—wit di Holy Spirit wey…
-
Romans Chapter 4
Abraham Dey Good By Faith 1. Wetin we go tok now, about Abraham, awa papa—wetin he experience? 2. If true-true na Abraham works make am good, he get sometin wey he fit use make-mouth—but no be for Baba-God front. 3. Wetin di Holy-books tok? “Abraham believe Baba-God, and Baba-God count am as goodness.” 4. Now, wen pesin hustle, dem no go tok sey hin salary na gift, but na wetin hin oga owe am. 5. But pesin wey no work, but believe Baba-God wey dey forgive sinners—hin faith go count as goodness. 6. David tok di same tin—wen he tok about di blessings of one man, wey no be becos…
-
Romans Chapter 3
Baba-God Faithfulness 1. Wetin you dey gain as you be Jew, or wetin you gain as you don circumcise? 2. E plenty well-well! First of all, Baba-God don put us in charge of Baba-God word. 3. But what if some of dem no gree believe? Shey becos dem no gree believe—con mean sey Baba-God faithfulness don cancel? 4. Lai-Lai! Even if everi- pesin dey lie, Baba-God na true. As di Holy-books tok about am, “You go dey right wen you tok, and you go succeed wen dem judge you.” 5. But if awa life of sin con bring out Baba-God goodness wella, wetin we go tok? Sey Baba-God no dey…