-
Proverbs 27
No dey make-mouth about tomorrow, becos you no know wetin di day go carry come. Make anoda pesin praise you—no dey praise yourself; make e be pesin wey no know you, no be from your own lips. Stone heavy and sand get weight, but wen mugu para—e dey heavy pass di two of dem. Vex no good, and to para be like wave, but who fit stand jealousy? E beta make pesin correct you for where everi-pesin dey, dan make pesin show you love for secret. E beta make your correct padi wound you, but kiss from your enemy na wayo. Pesin wey don belleful go hate honey, but even…
-
Proverbs 26
Like snow for hot season, or rain for harvest, naso respect no-fit mugu. Like birds wey dey fly komot, naso curse wey no be for pesin—no go fit fall on am. Flogging na for horse, rope na for donkey, and koboko for mumu back! No ansa mumu based-on hin level, or yousef go be mumu like am. Ansa mumu in a mumu way, or he go tink sey he wise. To send dondi message be like sey, make pesin cut hin leg komot, and drink fight-fight. Proverb for swegbe mouth, be like useless leg wey paralyze. To give mugu respect—be like make pesin tie stone for catapult. Like shuku-shuku for…
-
Proverbs 25
More Proverbs Of Solomon Dis one sef na more proverbs of King Solomon, wey Hezekiah, king of Judea—men write down. Na levels for Baba-God to code mata; and na levels for king to understand mata. As heaven high reach, and as earth deep reach, naso dem no-fit reason wetin dey for inside oba heart. Komot di waste material from silver, and di silversmith go fit produce jewelry. Komot wicked pipo from king side, and hin throne go stand gidigbam wit righteousness. No make-mouth for king front, and no go claim sey you be great man; e beta make he tell you sey, “Come up here,” dan make he fall your…