-
Proverbs 24
No envy wicked men, no wish to stay wit dem. Dem dey plan to shed blood for dia heart, and dia lips dey tok as dem wan take cos wahala. Na wit wisdom pipo take dey build house, and na wit understanding—house take dey stand gidigbam. Wit knowledge, di rooms go full wit everi fine-fine-tins, plus good tins. Wise man strong kakaraka, eehn..man wey like to learn go get more-more power. You need guidance to plan for war, and plenty advisers dey bring safety. Mumu head no-fit carry wisdom; he no get anytin to tok for meeting. Dem go know pesin wey dey plan evil as badbelle pesin. Yeye tinking…
-
Proverbs 23
Wen you sidon wan follow king chop, reason wetin dey for your front, Put knife for your throat, if you get longatrot. No let your eyes shuuk for hin mende-mende food, becos he fit dey try to deceive you. No kill yourself becos you wan make moni, use your common sense take maintain. If you put your eyes on moni, before you know moni don waka, e go fly like eagle go up-up. No chop food from pesin wey get tight-hand, no reason hin mende-mende food. Na di kain pesin wey dey always reason how much he don spend. He go tok sey, “Chop and drink,” but he no mean…
-
Proverbs 22
Good name beta pass plenty moni, and favour beta pass silver plus gold. Rich and poor pipo get one tin wey make dem resemble: Na Baba-God create all of dem. Man wey get-sense go see danger, and he go hide hin head, but swegbe go shuuk head and las-las he go suffer. To live jeje life, and to fear Baba-God—nahin dey bring wealth, respect, plus long life. Shuku-shuku and trap nahin full wicked man way, but pesin wey dey guard hin soul—no go jam all those kain tins. Train your pikin di way wey e suppose follow, and wen e don big—e no go fashi dat way. Bigman dey rule…