• Proverbs (Pidgin Bible)

    Proverbs 23

    Wen you sidon wan follow king chop, reason wetin dey for your front, Put knife for your throat, if you get longatrot. No let your eyes shuuk for hin mende-mende food, becos he fit dey try to deceive you. No kill yourself becos you wan make moni, use your common sense take maintain. If you put your eyes on moni, before you know moni don waka, e go fly like eagle go up-up. No chop food from pesin wey get tight-hand, no reason hin mende-mende food. Na di kain pesin wey dey always reason how much he don spend. He go tok sey, “Chop and drink,” but he no mean…

  • Proverbs (Pidgin Bible)

    Proverbs 22

    Good name beta pass plenty moni, and favour beta pass silver plus gold. Rich and poor pipo get one tin wey make dem resemble: Na Baba-God create all of dem. Man wey get-sense go see danger, and he go hide hin head, but swegbe go shuuk head and las-las he go suffer. To live jeje life, and to fear Baba-God—nahin dey bring wealth, respect, plus long life. Shuku-shuku and trap nahin full wicked man way, but pesin wey dey guard hin soul—no go jam all those kain tins. Train your pikin di way wey e suppose follow, and wen e don big—e no go fashi dat way. Bigman dey rule…

  • Proverbs (Pidgin Bible)

    Proverbs 21

    King heart dey for Baba-God hand, he dey direct am go where he like—like river of water. All man ways dey right to am for hin heart, but Baba-God nahin dey judge pesin mind. Baba-God prefer make pesin do wetin dey right and justice, dan make pesin give am sacrifice. Big-eyes, and buga for heart—evil man movement na sin. Di plan of pesin wey serious for business go surely bring yanfu-yanfu, but di plan of rush-rush pipo—go surely lead to poverty. Moni wey pesin make wit wuru-wuru tongue—na dream wey no dey last for pipo wey dey fyne death. Di blood shed of evil pipo go make dem kpeme, becos…

No copy from dis website