-
Proverbs 10
Solomon Proverbs Proverbs of Solomon: Wise pikin dey give hin papa joy, but mumu pikin dey make hin mama sad. Property wey pesin obtain—na waste, but clean-hands dey save pesin from death. Baba-God no go let hungry beat righteous man, but he dey dabaru badbelle pipo wish. Lazy hands dey make man poor, but hand wey dey do business dey bring moni. Any-pesin wey dey work hard for harvest season—na wise pikin, but pesin wey dey sleep for harvest na pikin wey dey bring disgrace. Blessings na crown for righteous pesin head, but fight-fight nahin full badbelle pipo mouth. Di memory of righteous pesin na blessings, but di name of…
-
Proverbs 9
Wisdom And Mumu Wisdom don build her house, she don form seven pillars. She don prepare her food, con mix her drink; she don set her table sef. She don send her house-girls go out. She dey halla from di place wey high pass for di city, “Make pipo wey no know anytin—come here!” As for di man wey no get understanding, she dey follow am tok! “Bia, chop my food, and drink di wine wey I mix. Fashi mumu level—make you live; follow di way of understanding. “Any-pesin wey correct mugu go receive insult; any-pesin wey correct wicked man—dey wound hinsef. No correct mugu—or he go hate you; correct…
-
Proverbs 8
Wisdom Dey Call Abi wisdom no dey halla? Abi understanding no dey raise her voice? She dey stand on top of di highest place, for corner of road, and for junction. For corner of di gate of di city, for doormot, na for there she dey halla. “I dey call una, nnaa men, I dey halla all of una; I dey raise my voice to everi human being, You, ‘ordinary pipo,’ understand wisdom: and you wey be swegbe, try to get heart wey sabi understand. Listen, I get beta tins to tok; I dey open my lips dey tok wetin dey right. My mouth dey tok di truth, and wickedness…